Katharine Mary Briggs
(8 November 1889 - 15 October 1980)na one
British Folklorist
an raita,wey rait
The Anatomy of Puck
, di four folum
Dikshonari of
British Folk-Tales
inside Inglish Langwej,an Meni oda buk dem on top
Fairies
an
Folklore
.
From 1969-1972, na shi bi di president of di
Folklore
Sosaiti, wey yuz im nem tek establish one awod tek
commemorate
Im life an wok.
Dem bon Katharine Briggs for Hampstead,London.Na shi old pas for di three girl pikin dem wey Ernest Edward Briggs bon an im kom from Yorkshire (Im famili do wel an get plenti moni for di mining wok wey dem do for Halifax an for Wakefield), an Marry Cooper.Im oda two sista dem nem bi Winifred an Elspeth Ernest bi
Water hiColor
artist wey get speshal i upnt noerest for 'it'Scottish scenery
an Im dey always tell Im pikin difren difren stori an e bi like sey na dis stori dem kom mek Katharine get lon time intres.Di famili kom muv go Perthshire for 1911,Wie Ernest biud one haus ,
Dalbeathie
haus.
Ernest dai for die afta two yias for 1913.Katharine bigin to dry go
Lady Margret Hall
,Oxford for 1918, an shi kolet B.A for 1922 an stil kolet Im M.A for 1926.Katharine kom go back to dia ples (bikos of di famili coal
legacy
, an one
Collieryfor Normantaun,shi no nid to dey find wok),shi jus bigin todey rait an dey do play dem- Al Im famili dey enjoi di tiata produshon dem, an na wetin Katharine want for im life bi dat- an shi stodi
folklore
an 17th- senturi Inglish Histri.
Shi gain im Ph.D wit one
thesis
on top folklore inside
Seventeenth
senturi litresho(
Folklore in Jacobean
litresho) afta di sekon wold war; during di war, shi don dey don tish for one Polish Skul an wen shi wok
for di medika bransh of di
WAAF
.
Briggs kom bikom pesin wey pipul know
Wel- wel as
Folklorist
.Afta Im first
buk on top
Fairies
,
The Personnel of fairyland
,shi kontiniu to rait Meni oda buk dem on top
fairies
an
folklore
inkludin
The Anatomy of Puck
an
It's Sequel,Pale He ate's Team(1962)
.
An Encyclopedia of fairies(1976)
;an shi even rait Meni buk dem for smol- smol pikin dem like
The Legend of Maiden-Hair
(di first buk wey shi poblish)or
Hobberding Dick,
an
Kate Crackernuts
.
A Dictionary of British Folk-Tales
for Inglish Langwej: Part A:
Folk Narratives(1970) wey shi ripobish for three volume for 2011 as
Folk Tales of Britain
,an Phillip Pullman tok abaut am wen e dey do di introdoshon sey na di koleshon ful pas an naim get otoriti pas for British
folktales
wey dem don do.
For 1969,dem giv am Doktorat awod for Litresho an kom mek pdi president of Folklore Sosaiti.Shi dey do post of president on til 1972, an dem tek Im nem tek dash one awod wey dem go dey giv pipul.